Some reports wey dey come from Borno State for northeast Nigeria don show say some local goment areas dey under Boko Haram and Iswap control.
For weekend, Senator Ali Ndume yarn dis one for tori pipo for Abuja say three local goment areas currently dey under Boko Haram control.
Di local goments na Gudumbari, Marte and Abadam.
Recently, Borno State Govnor Babagana Zulum complain say Boko Haram and Iswap attacks don increase again for di state. E tok say federal goment gatz take action bifor di mata worse pass as e be now.
Pipo wey dey live for dis places tell BBC News Pidgin say dem don dey under Boko Haram and Iswap control for over six years, and dem dey live inside fear evriday.
One resident from Gudumbari wey no wan make we mention im name sake of security reason tell BBC News Pidgin say since 2018, dem never get any help from Nigerian military. E say dem dey under control of di terrorists afta dem attack and distroy military base wey suppose dey protect some villages for Gudumbari local goment.
"Since 2018 wey dem scata di military base, about ten of our villages don fall under Boko Haram and Iswap control.
"Now, na only Gudumbari headquarters still dey under military, but almost all di villages for di local goment dey under terrorists," e tok.
E still add say, "Our pipo wey dey live for dia bin dey always dey fear sake of say di terrorists dey waka round time to time."
E tok say Boko Haram and Iswap dey collect tax and food from pipo becos na farming di pipo sabi do.
"From time to time, dem go come collect food, especially afta harvest. Dem go still collect tax from pipo hand."
E tell BBC News Pidgin say sometimes dem dey punish pipo wey do anytin wey wrong.
"If pesin do wrong, dem go punish am or flog am."
E also tok say as e be now, nobodi fit waka comot from di local goment go Maiduguri sake of security wahala.
"If you see anybodi wey dey comot from Maiduguri to Gudumbari, na either wit di govnor convoy or soldiers escort," e yarn.
UK Supreme Court give legal definition of woman
Ponzi schemes wey don crash for Nigeria in di last 10 years
No civilian dey live for Abadam local goment
For Abadam local goment, di mata worse sake of say nobodi dey live dia again due to security palava.
One source tell BBC News Pidgin say almost no human being dey live dia apart from soldiers wey dey for di local goment headquarters.
"Now, na only soldiers dey live for di main headquarters sake of say all di pipo don japa to save dia lives."
"About half of di pipo for dat local goment don run go Niger Republic as refugees, odas scata go nearby states for Borno."
Di source also tok say pipo no fit waka straight for road go Maiduguri again, dem gatz pass through Niger Republic.
We no fit buy food stuff alone unless we dey travel wit soldiers
For Marte local goment, pipo wey dey live dia don still run.
According to one resident of di area, Babagana Ali, nobody dey live for di old Marte town again.
"Up till now, nobody dey live for old Marte local goment. Some pipo now dey live for New Marte wey far like 12km from di old town."
E tok say pipo for di area dey live in fear sake of say Boko Haram dey attack dem evri few months.
"Pipo dey live inside fear sake of say from time to time, terrorists dey attack us for New Marte wia we dey now."
E add say anoda kasala wey pipo dey face be say dem no fit waka go nearby town like Dikwa go buy food stuff.
"Pipo no fit go buy food unless na month end, wen soldiers go use convoy escort dem."
Di residents dey beg goment and oda pipo wey fit help to come bring beta peace to dia areas.
Borno State don dey struggle wit security palava for more dan 10 years, and e claim so many lives and also force so many pipo to comot from dia homes.